Ticker

6/recent/ticker-posts

Boxer banned from stadium for pummelling football referee

 





My people, Court don ban one upcoming boxer wey use football referee dey start hin b0xing career, court say make e no watch sports games again make e dey watch from house.


Adam Abdallah na upcoming boxer and camera bin capture the bobo when e bin dey pUnch(bl0w) Kodr Yaghi wey be referee for one match wey two Amateur Australian clubs wey be Greenacre Eagles and the Padstow Hornets bin dey play for April 2023.


Although dem no tok why the bobo knack referee like pikin wey tiff that day, but the upcoming boxer commot four 🦷 teeth from the referee m0uth still give am serious mark for bodi na im make police carry am go court.


Their plan na to give am beta pun!shment but judge later change mind after dem show am video evidence wey show say na the referee first throw bl0w e no know say the boy na boxer.🙆


Now dem don judge the matter finish, dem tell the upcoming b0xer make hin no watch any sports games again untill further notice before e go kpai person so na for television e go dey watch and e still pay fine.


My people abeg shey this pun!shment no too much since dem don see say na the referee first find the bobo wahala?.🙆

Post a Comment

0 Comments